I see one orange for sky,
E fat well well,
And e ripe well well,
E hot pass fire,
But im beauty pass that of Clara.
I carry my head up,
This orange for sky too hot,
E be like say my head na pot,
Plenty sweat, I sweat no be small,
Like hot water na im the thing dey boil.
This my waka no be small,
And me I no mind at all,
This my waka no be small,
Wetin I dey find…
Na im give me liver chop.
Water wey fine wey clean,
Water wey dey halla, wey dey jolly,
Water wey big, wey dey fall,
Water wey im “gbosa” “gbosa” no they stop,
Dem talk say e dey,
For one forest, wey far tey tey,
Big bush for Ikom village, na im e dey.
”E go dey?”, I com dey reason,
The thinking dey totori my belle,
Although hunger don wire me tire,
My belle me I no send o, I no go tire,
Because that water I must to find and put for camera.
Although my sálú bàtà dey halla,
Even my leg sef don worry tire,
Na Sharp sharp I clear them:
“warri boy no dey carry last, una hear am?”,
Because…
Agbokim waterfall na the water,
Wey go cure my àrìnká,
even if to find am go já my bàtà
– Agbokim Waterfalls, Cross-River State, Nigeria.
This article was written by Folarin Kolawole
Founder of Naijatreks, Nigerian-born Folarin Kolawole is a geologist, travel writer and researcher. When not at work, he travels the length and breadth of Nigeria, exploring, taking photos and writing about her numerous hidden tourist potentials. 'Naijatreks' is a product name registered under the Ntreks brand, which is also duly registered by Nigeria's Federal Corporate Affairs Commission. The contents on this blog are re-usable. However, it must be ensured that it is linked back to this blog, and correctly attributed to Naijatreks or the author. Please do not edit, rewrite or commercialize the original works on this blog without direct and written permission from the Founder (Folarin Kolawole). For inquiries and advert placement on the blog, kindly contact us at info-naijatreks@doc.com or naijatreks-doc@gmail.com.
11 comments:
Ok this is beutiful and it connects. ‘…totori my belle…’ I thnk some one is getting baptized with the Warri version of pidgin. I love love it. Will do something like this sometimes
brother abeg show me the way,

when you don find the place
welldone Folarin the Nature man
@ femi…loll…tnx bro…and who is being baptized with warri pidgin?…loll…I guess I have stayed too long in the Niger Delta for you to have started making such observations…loll
@ Tolu…don’t worry bro….you sure know the way…your compass is your faith…
Hehehe…Wonderlust dey cut shoe (A turtle goes in search of a waterfall speaking pidgin english) http://naijatreks.com/2011/01/wonder… via naijatreks.com
@feeldflow hell bro! nice work with Naija treks…following u and hoping to know more bout tourism
Tnx bro…grt meeting u…@segebee
nice one bro…got the Niger delta spirit already bro…hmm.guess u av also started seeing thru their eyes to….lol
@ Click…loll..Niger Delta spirit indeed…loll..must anything pidgin be attributed to Niger Delta?..thought pidgin english is more like a national language now though
Beautiful water fall u found, I owe u a new shoe when you get back from your journey. But dis time pls don’t ja d bata. Good job
@Demzyjay…hehehe thanks for the promise of a new shoe ohh…don’t worry, I won’t ja d bata ok…you’re a good man…but na wa for you o, why didn’t you drop your address na, so I can come pick my shoe??